Monday, August 26, 2013

JOKE ON CHINKO PHONE and BLACKBERRY " meaning Nigerian Jokes On China Phones and Blackberry!

Blackberry don chop my money tire, na hym I come
vex yesterday sell am, come take some money from the one wey I sell the BB, buy China phone!

Now am in bigger trouble!!!
1. E go full after 3minutes of charging.
2. The phone get TV, Touch screen, AirCondition,
TorchLight, Nail cutter, Mirror,Firelighter, Opener
etc.
3. I fit write Text message with a toothpick sef.
4. The spelling get mistakes e.g NokLa, blackderry,
i-Indecency, samswag, LD etc.
5. When aeroplane pass e go record "One missed
Call".
6. When a big truck horn; e go show "Charger
connected" .
7. When Chinese man pass e go show: "One
Bluetooth device found".
8. When fine gal waka pass, e go show "U have a
new msg".
9. When ugly gal waka pass, e go show, "Virus
detected".
Abeg I wan sell am! Who wan buy oooh?...
Even as I dey find buyer,e dey show me for screen:
"No contact found"

No comments:

Post a Comment

POST COMMENTS! NO NEED TO LOGIN

Search This Blog